xxx of yyy characters
Join Group
Google Translation: Off

When Google Translation is on, topics and messages in this group will be machine-translated to your language by Google.

Messages


Topic: White Christmas 'with' Nigeria..?
Naija Guy and babes.. I dey hail O! Just a crazy idea that i'd like to share.. I was thinking, since many of us, especially we, the younger generation (I no be small pikin sha..)won't be able to go to Nigeria for this season's Christmas holiday, I was thinking.. hmm.. I think what i'm about to say sounds better in pidgin english:

as i been dey talk.. as we no go fit go Naija go relax, we or arrange ourself dem for this side. In short, I been wan say make we hold all-Naija gbedu for london here.

No be arrangee be this, as i know say(unfortunately) some of our Naija bros dem dey give us bad name. But, if anybody wan gyrate with our fellow bros dem this holiday, make una just halla me back make i know how many people dey interested.

I been dey think of 29 or 30th December for de main gbedu wey go include talent hunt and mystery guest, plenty plenty games and several other enjoyment things: No formal anything, na just come enjoy urself and meet other fine fine Naija Guys And Babes~(Una know say na we fine pass).

Abeg, I wan make una also suggest the kind things wey una feel say we go fit do wey we go take enjoy ourself that day. Make una halla me with una suggestions.

Abeg spread the word. Naija go soon happen for London

Una Man
Ini
Oct 31, 2006
12:24 PM

Posted by Ini Ubia

Note: To add an image or link in your message, use <img src="http://www.hi5.com/example.jpg"> or <a href="http://www.hi5.com/example.html">Text </a>

 
 

  

Title
body
 

Purchase additional coins

You need an additional: hi5 Coins hi5 Coins

Get Coins No Thanks